NAIJA PIDGIN CHALLENGE - OGBONGE YARN WEY CONCERN WE LIFE

in #npc7 years ago

image

@ogoowinner Don say make we personalise dis yarn con translate am to pidgin... Na my pledge b dis ooo

I grab say i get the right say make people kno say i dey, make people hear my tori and make I dey sweet and totori people for belle

I grab say all we people na d same

I know say we obodo earth e big sotaaay e go do everybody remain

I know say I get beta sense for even if na one side wey consine me wella

I know say I dey important wella and I get very important tin abt me

I gree say I get both good and bad side, so I go try everything I fit do to hide my bad side and showcase my good side

I gree say where I from, who I dey serve and my level for life no b anything but na wetin people wey like to argue don talk so dat dem fit use our head, make us hate oursef and cos us to think say dis person big pass dis oda person. So I don say I go be human being first before I go look where I come from, who I dey serve and which level I dey for life.

I go do people d way wey I want dem to do me

I no go follow people becos of wetin dem be, but wetin I want dem to become

I no go follow do any business or anything wey go cause bad tin to happen to my fellow person

I go try wella to know people well no b say I go dey talk abt dem or judge dem anyhow

I no go gree make badbelle, to dey vex wen I see person, and big eye to use my head and how I suppose do tins

I go make sure say I reach even if na one big tin for the people before I caput comot for we obodo earth

I go try well well to make I say I stand gidigbam for front of all dese tins wey dey make me cry and worry

I no go gree make fear pour me charge

I no go gree make bad tins enta my mind, I go vamus am sharparly con put sereren tins and tins wey go make we life beta because I know at wey I dey think get get strength kakaraka

I go dey be my self, my main self, no b counterfeit

I gree say I fit do wetin person neva do if i use my mind do wetin dem say make I do

I gree say life ma travel ooo no b on ur maths, so I no go gree myself to do on ur maths with anybody

I stand gidigbam fr sereren werere

I stand gidigbam for we to help people

I stand gidigbam for we to leavam wen people vex us

I stand gidigbam for we to dey sweet ourself for body

I stand gidigbam for mercifulness

I stand gidigbam for we to treat everybody d same

I stand gidigbam for human beings wey dey live

I don promise myself say I go dey korokoro, I no go jst dey like wetin person think say been dey

I @effey go make sure say I follow this yarn till I caput comot fr dis life.

Tnk u @ogoowinner fr this inspiration oooo.....10 gbosa fr ur head👊👊👊

Na we person funke akindele naim I use fr we pishure ooo from naijanews. com