WETIN STEEMIT DON DO FOR ME (a pidgin challenge by @ogoowinners)

in #npc7 years ago (edited)

image
Beautiful street view of my area for abuja

My country people for this steemit community I throw salute for all of unah (good morning gee)
Oya make I come activate my pidgin levo for this area but before I yan make I first thank madam @ogoowinner wey organize this challenge for we language wey no be like oyinbo own this time.
MAKE I FOLLOW YAN MY OWN TORI WHY I JOIN STEEMIT
Make I first tuwale for baba God cas nah em hand I dey o.
This hustle wey we dey hustle we no go rest o until the hustle pay one day.
The true matter be say I don suffer wella for Ponzi scheme die, last year everybody just the suck my money like draw soup from MMM, TWINKAS, GIVERFORUM infact everi everi when I say make I come try SWIZZGOLDEN that one self the tori long, as I come the yan my paddi @ememovic the tori em come introuduce me to steemit say the place sure die and nah were dem go fit the pay me for waiting I write.
Nah him I run enter o, as the matter be ehn me self kuma no come sabi write tori for my life before but since I join steemit the matter don change o nah so so tori I dey learn how to write, as least steemit don make my writing and reading life better pass as e dey before.
As I dey yan you this tori nah every time I d dey on steemit now lol.
Steemit e go better for unah jare
Genesisproject unah too much unah blessing self full cup.
Aunty @ogoowinner your head go continue the get oil and plenty SBD for your wallet
And make unah no forget to show me love.
I be that unah small boy @oliverwilliams

Sort:  

Funny Guy. Ur pidgin correct die..One love from a Nigerian..

I trowey salute for u my brother, nah pidgin we know if u dey with me self we go fit make e for turn Nigeria official language

Guys na beginner I be oo make una konnect me..

Making sense somthing

This is beautiful .u too sabi this pidgin o.