Happy christmass in advance, As He remain 5 days From Today.

in #pidgin-english7 years ago (edited)

Helo my people dem, Wetin we dey prepare for, done dey For one corner dey wait.

Today na 20 of december month and all of us sabi say na that on 25th day be the date wey carry the weight, Upon say no be on that 25 day dey carry all the enjoyement for head. But wetin special for the date be say na the day wey dem tell us say dem born Jesus Christ, Christian Dem Oga Boss. Everybody sabi say na that day be the special day wey dem christian dem they celebrate dem Oga Boss birth day. A week After that day na new year be that na him make christmass holiday dey sweet well-well. Weather you be christian, muslim, judaism, or traditional man, Any part wey you belong to, You must follow enjoy christmass holiday.

Better things dem wey dey follow make christmass holiday special for my eyes na

  • Christmass tree-top and he shine-shine
    b9db9bfe75e6a50914d5517f4fddc0e7--christmas-tree-ideas-woodland-christmas.jpg
    I collect dis picture from here
    Chrismass tree-top follow make the season self dey sharp, if you go bank, shoprite dem, some shops, some people dem house you go see say dem don mount am. Na that time you go begin notice say no be small thing as the shine-shine go dey shine like star you go begin notice say we won enter new year even if you no sabi time and date, As the star mean new start for my own eye, na him be say old thing done go as we dey enter new year, we dey enter new life be dat.

  • Another betta opportunity wey dey bring family back to village make dem fit see again
    Family02.jpg
    I collect dis picture from here

Another thing wey dey special to me for dis holiday be say na him dey draw me come back home, draw my uncle home, draw my aunty home, make me relate again with some of my child-hood friend dem.
He dey make sense for my side if all my family do meeting again, see my people again, chop together, na big Joy for my side.

  • Rice, chicken, turkey and party dey always dey special from dis period
    images (9).jpg

Na this part dey funny me pass, E go make you feel like say the chicken wey you dey chop for the christmass period na special one, like say dem send am from abroad. E go even sweet you pass like say you neva chop chicken before.
Party wey you dey go for dis period na special one. Na this period dey make you spend like sey you be Dangote or @dan for steemit.
If you dey spend your money, e go dey sweet you for body and you no go complain.

Time wey dem dey buy new fine-fine chrismass cloth and shoe for you.

Na this part sweet me pass when i dey small, time wey we dey collect special gift and give people gift too.
Christmass na another opportunity wey go make you fit ask anybody for christmass gift even if na your enemy he still fit consider am.
When i small i dey recieve gift well-well, even till now. Na so i dey give well-well too.

Thank you as you read my post.

Drop your own mind join, ontop coment box. How christmass take dey special for your own eye with #pidgin-english, make we for fit catch small fun ontop steemit.

If you go like to support wetin i dey write, Abeg you fit give me Upvote, Comment and Resteem

IMG-20171012-WA0016.jpg

Make we dey Rapon

Sort:  

abi? happy christmass in advance my peson..