PAPER DREAMS

in #writting7 years ago

it starts ova again...
Wishing evryday dat I culd hurry gain,
Cuz riches na fine weather, poverty na hurricane,
N dese days dem no care from where d moni came,
Tosan bin dey yarn me just d other day,
Omas don make moni thru another way,
d way girls don dey polite for am pass customer care
And dis na guy wey dem bin hate d former year..
No b say omas fine, omas no dey attractive,
If na only omas dey Eden, him no go attract EVE,
But now him cliq don dey call omas "The BREEZE"
Cuz eva sinc him BLOW, him dey open chicks yansh wit ease.
Na Alero matter even suprise me pass,
Person wey dey borrow uniform take go class,
Now alero don dey follow Alhaji shop 4 dubai.
dey wear d kind tins wey fit make u ask wetin she go 2 Buy.
Dis na girl wey dem bin dey call "Pastor wife"
But she don dump d fiance n him Pastor life,
As dem wan break up, she give am one flow:
"How u go say u b virgin, u wey Owu don Blow"
Its all about d money, for omas and Alero
Cuz d way poverty BEAT dem spoil deir acapella,
And dem no kon fit patient make moni thru d right source,
Whether na blood money or G, dem must make am by force
omas don dey show area wit range rover sport,
I tell Tosan say I choose Music over sport,
Misan wey comot 6 years ago 2 chase football dreams,
We never still see him jersey for any of d football teams.
nobody own worse pass, we all got paper dreams
Evrybody want to b landlord, sky scraper tins...
I no dey judge anybody, me sef i get my dreams
I dey reason if ferrari fast enough to chase my dreams,
If I no make money, GOD no go happy wit me.
But if I do blood money, shei him go hapi wit me?
Baba GOD, pls grant us patience to make moni d right way.
Before desperation take over.type.jpg