You are viewing a single comment's thread from:

RE: Naija Entertainment Artistes

in #naijapidgin7 years ago (edited)

Some people go say na them be bad, some go say na them be badder and another one go talk say na im be baddest. But una don hear of BABA NLA before. I no know why all of una no mention Wizzy ooo. Make I no waste una time with any introduction because how you go talk say you wan introduce wizzy . Wizzy be the one we know as Baba Nla. No be Baba Nla by name alone, na baba nla by voice, baba nla by performance and finally baba nla with fine, fine girls. Wizzy don big sote he don make plenty plenty international collabo with big boys and girls abroad; drake, Rihanna, Beyonce etc. This guy big sote Africa no fit contain am.

Them girls come love am die and na so my guy no dull he just dey give them belle dey go. People talk say na only him fit break Charly boy and 2face record when it comes to woman mata.

Wizzy just dey start because he never even do anything. Make una watch out for Wizzy in this 2018.
Baba NlaWizkid.jpg