Naija Entertainment Artistes
Ma country people how una dey, I trowey salute give una oooo.
I welcome all of una to our ogbonge naijapidgin blog.
As una know say today be monday (the day of financial success) na business we wan carry am do.
Our today tori go take another swag another effizzy as we go dey chuk mouth for matter wey concern our naija entertainment artistes.
Who ur artist be?
How we take reason the matter, as I believe say everyone get him own entertainment artiste, se na comedian abi na film or music industry ur goons dey, oya make we talk am.
@naijapidgin entry
Dis guy na my real G, him name be Olamide Adedeji a.k.a Olamide. He dey known by most naija pikins and im popularity be like whale's own for this our community.
How I Take Like Him.
Ma koko reason wey I take be a fan of dis guy be say he truly belongs to d street, I believe say u grab that word 'Street', na always him dey give out to the street both money and music trends. Also him dey always praise his naija people with love and good heart.
So wetin we wan make una do be say:
U go upload ya correct artist pictures and the koko reason why u take like him/her or be him/her fan..
Person wey yarn correct thing stand a chance to go home with a recharge card tonight.
No forget to follow us for our tellegram group tonight , if u neva join click here
Na @horlaide create dis post for naijapidgin
Avartar designed by @mittymartz
Source
No. 1musician na Ayoleyi Hanniel Solomon him stage name na Reekado Banks name wey I dea personally call am na Reeky Standard because say the guy just dea too good, as in ehn the nigga dea burst my brain, they born the superstar on 6th December 1983. Na naija pikin him be recording artist, singer and songwriter. Na Mavin Records sign the Bobo. Them declare am as the Rookie of the Year for The Headies 2014, and him win the controversial Next Rated award for The Headies 2015. Him debut studio album, Spotlight wey released on 1 September 2016. It debuted at number 10 on the Billboard World Album
Also known as Spicy
Genres Afropop
Occupation na confirm Singer, songwriter, performer
My confirm guy...goodluck dear
Success
Goodluck
Go girl
All the best
I don vote am ni
Abeg carry watin dem wan share for you reach mi domot o
The person wey the give me joy Na the man with the magic voice.
the man name Na Nathaniel Bassey.
the man trumpet the give me joy.
the man Na real gospel minister.
e dey give you exactly wetin you need for gospel music.
you know that moment wen you go dey very quiet.
the next sound wey you go hear from your phone Na
instead of you to pick the call, you Need To do small worship first.
Some people go say na them be bad, some go say na them be badder and another one go talk say na im be baddest. But una don hear of BABA NLA before. I no know why all of una no mention Wizzy ooo. Make I no waste una time with any introduction because how you go talk say you wan introduce wizzy . Wizzy be the one we know as Baba Nla. No be Baba Nla by name alone, na baba nla by voice, baba nla by performance and finally baba nla with fine, fine girls. Wizzy don big sote he don make plenty plenty international collabo with big boys and girls abroad; drake, Rihanna, Beyonce etc. This guy big sote Africa no fit contain am.
Them girls come love am die and na so my guy no dull he just dey give them belle dey go. People talk say na only him fit break Charly boy and 2face record when it comes to woman mata.
Wizzy just dey start because he never even do anything. Make una watch out for Wizzy in this 2018.
Baba Nla
The naija artist wey me like well well na Douglas Jack Agu a.k.a "Runtown.
The bobo fyn finish and i like dey way e dey sing and rap.the bobo no stingy at all.i also like how e dey dress.The guy swag no be here.im dance dey give me joy.i no dey play with im music.i don make my friends like the guy music.
The guy voice sweet pass honey thats why fans like am well.Ma friend Runtown get talent.the way e dey sing go make you no sey the bobo dey talented.Abeg make una follow me like my guy.
Thnaks for following our blog
My country pipo, na our own TY Bello be this.
The koko reason why i take like her be say
She dey always show say naija get hope and correct tomorrow even with all the wahala wey dey now.
And she be like ginger for we Naija youths as she dey do plenty things like her song and this photo wey she dey snap.
She be correct naija artist
Una dey well o
My own favourite naija artiste na Bankole Wellington a.k.a Banky W. I like this guy because of him soft voice, mature lyrical content, unique style and ultimately, him real profession.
If dem tell u say Banky W na structural engineer, u go ever believe?but 2 show u say d guy 2 much,e leave structural engineering profession,enta music come still make am big....
I komot cap 4 u joor olowo ori Adesuwa, ur head no big 4 notin o...
@naijapidgin, i hail o...
But I hear say the guy don close shop faa
The pottery is very good, the post is very good friend
In name na David adedeje adeleke but them know as well well to bi DAVIDO.
Him they write song and record producer.
Them born am for the month of november 21/1992.the CEO of DMW.him start hin music career with one music group wey them called KB international.him first track there be BACK WHEN.later him con sing one single for 2011 title am DAMI DURO that song en,egbe know bi small gbege e kos ooo.e waka like mad person
Why me like this dude be say him know because say him father get money make him sitdown know do any thing.they labish him father money.him still they they huzzle.him good for waiting him they do.him sabi sing and they drop weytin people they like.weytin make me like am again be say him they always spend big money for songs video.if unah go remember him shoot skelewu video reach 5times because say him won give better video.him get music agility and video swag.ok see.2017 him drop one song title IF that song waka all over the country,na the video again we won yan.that same 2017 him still drop another music wey them tittle am FALL wait ooo e never finish still that 2017 e still drop this one tittle FIA wey be say almost 100.000 people download am for just 2month that 2017 him.still drop LIKE DAT.and the four music waka every where.na me and davido for life.thank you @naijapidgin say unah bring this kind tin come out.
You like this man no be small. See the plenty thing you write about am
The bobo wey i like pass na
Aboriomoh Femi Raymond
Him dey 24yrs old
And them born am for Ogun state
As una see for the the picture the bobo na fine boy
And him na rapper, singer, song writer and record producer. Him former record label A. P. P. E, but now him dey D.M.W
I like the bobo music well well especially the one wey him call "Who" lol.
And i like him music and video style cos the bobo get swag no be small
Abeg make una follow me love this bobo cos i no fit like am less him too much
@naijapidgin thank you for helping us talk about who we like God bless you